ADVERTISEMENT

REVEALED – How Troops Take Rescue Kidnap Victim For Enugu

ADVERTISEMENT

REVEALED – How Troops Take Rescue Kidnap Victim For Enugu

 

Related posts

ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Soldiers wey dey 103 Battalion of 82 Division Nigerian Army wey dey Operation UDO KA II, don rescue one pesin wey dem kidnap, Dr. Maxwell Ayim for Road Four Corner-Agbogwe for Udi Local Government Area for Enugu State.

Na so di tori waka enta for statement wey di Director Of Information of di 82 Division, Lieutenant Colonel Jonah Unuakhalu yan for Friday.

E yan say, di rescue operation happun wen troops wey dey Udi checkpoint get emergency call from police about di mata.

“For di place wey dem waka go, troops jam di kidnappers. But as dem fire beta beta, di bad guys run enta bush with wound from gunshots. Our soldiers no gree hear say di gang run comot, dem waka chook eye for di place wey dem carry di man run. Dem rescue di man and e don waka go meet him pipo afta we dem check am for hospital,” na so di yan enta.

E still add say Operation UDOKA II, wey be Joint Task Force, dey beg pipo wey sabi beta beta tori for Enugu State and di whole South-East make dem dey give dem informate wey dey tru so dem go fit knack full stop for kidnapping tori and any oda bad bad tin wey dey di region.

Operation UDO KA II also yan say dem no go gree make criminal tori for di area.

Share this post

Facebook
WhatsApp
Twitter
LinkedIn
Telegram
Email
Print

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Kindly accept our Terms & Conditions and Privacy Policy .

Related Posts

Welcome Back!

Login to your account below

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.